On Air Now

Non Stop Music

11:00pm - 6:00am

Fire for Ihiala Nkwo Market

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Anambra State Government don console Ihiala people ontop the fire wey bring down the Nkwo Ogbe market Sunday

Anambra State Government don console Ihiala people ontop the fire wey bring down the Nkwo Ogbe market on Sunday, dey promise to lead the mobilization of the people on top planning, designing and building a modern market for the town.
The state Commissioner for Information and Public Enlightenment, Mr C. Don Adinuba, for him yarns on behalf of the government, yarn say the fire chop be only just the buildings and market stalls but also vital goods and even raw cash.
He tok say the state government go set up a panel wey go find the causes of the fire and also make suggestions on how to prevent am from to happen again, and e b say this na the fourth time fire mata don sele inside and around the major market in recent years.
The commissioner also tok say the state government go seek to complete the establishment of a fire service for the town, although him come las las tok say the facility fit no get head for the market, if dem no provide things like beta roads.


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 25°C