On Air Now

Closing Joli Joli

6:00pm - 11:00pm

FG Don Declare June 12 as Public Holiday

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Federal Government don declare Monday, June 12, 2023, as Public Holiday.

Di Permanent Secretary, Dr Oluwatoyin Akinlade na eim make dis annoucement on behalf of Federal Government.

Dis one na to remember and celebrate dis year Democracy Day.

Dr. Akinlade come hail Nigerians say dem stand strong for democracy mata even though wahala and gbege bin dey. 

He still tok say make we gather celebrate di small betterness wey dey happen as we dey expect better future.

How una see di mata?
#chookmouth


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 25°C