On Air Now

Una Wake Up Show

6:00am - 10:00am

FG Don Approve joining of ATM card and National I.D Card

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

FG don approve policy wey go let ATM card to fit be I.D card.

Commercial Banks fit give ATM cards wey fit still be National Identity Cards.

Di Minister of Communicatins and Digital Economy, Isa Pantami  tok dis one for Abuja. He tok say dis one go be 2-in-1 card as you fit use di card as ATM card and you go fit still present as National I.D card. 

Di Fedral Executive Counci (FEC) na eim approve dis one on Wednesday for dia siddon discuss.

Pantami still tok say, even though di NIMC Act 2007 tok say every citizen must get NIN even if you no get di card but now request for di National I.D card don dey too plenti na eim make dem do dis one .
   
How una see di mata?
#chookmouth


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny

    High: 38°C | Low: 27°C