On Air Now

Non Stop Music

11:00pm - 6:00am

Family of Seven Die Afta dem eat poison for Zamfara

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?
Police for Zamfara tok say even family members die afta dem eat dia local food Dambu wey dem make from corn and vegetable.

Police for Zamfara tok say even family members die afta dem eat dia local food Dambu wey dem make from corn and vegetable.

Police  command  Public Relations Officer, SP Mohammed Shehu, tell  News Agency of Nigeria (NAN) say dem don start to di touchlight wetin make di family members die for Danbaza village, Maradun Local Government Area, Zamfara. 

“The incident happen on Monday afta di family chop di food wey dem cook for night food.

“Di police don take samples of di food wey dem chop make dem test am, dem tok say dem go release di result to tori pipo,” Shehu tok

Pesin from di village,  Muhammad Kabir, who dey close to di family tell NAN say four of di family members die on di spot while di remaining three die afta dem rush dem go hospital.

 


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Thundery shower

    High: 36°C | Low: 26°C