On Air Now

Closing Joli Joli

6:00pm - 11:00pm

Etche Traditional Ruler Don Kick Against Bad Name Wey Dem Dey Give Etche People

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Di youth activist don call on di traditional rulers and youth groups for Etche make dem rise up and put better security for di area to fight di crime wey dem dey report.

E still beg di Etche LGA Chairman, Chima Boniface Njoku, make e put security for front and do more to protect di people wey dey stay for di area.

As people still dey call for more security, one traditional ruler for Etche don come out to kick against di bad name wey dem dey give Etche people.

Di Onye-Ishi-Agwuru, Third of Ulakwo-Umuselem Clan for Etche LGA, Ken Nwala, don blast di people wey dey spread bad tori about Etche people.

Eze Nwala sai anybody wey dey spread dis kind tori fit no really know how Etche people dey welcome people and how dem dey make pesin feel at home.

Comments

Add a comment

Onitsha Weather

  • Onitsha

    Light rain

    High: 30°C | Low: 24°C