On Air Now

Oga Madam Office

10:00am - 2:00pm

Eletion: Atiku, Obi, Tinubu, Odas Sign Peace Accord

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

The presido candidates of all the political party dem wey dey inside wey obodo Nigeria don join hand take sign thr second peace accord, wey go make sure say dem no do or join bodi for any gbege level inside the election.

No be just the candidates dem even the chairmen of the parties dem follow sign the accord wey National Peace Committee, arrange on Wednesday.

Atiku Abubakar from the Peoples Democratic Party (PDP), Bola Tinubu from the All Progressive Congress (APC), Peter Obi from the Labour Party, and Rabiu Kwankwaso from the New Nigeria Peoples Party (NNPP) sign the accord.

Other people na Omoyele Sowore of African Action Congress, Hamzat Al-Mustapha of Action Alliance, Sunday Adenuga of Boot Party, and the only woman candidate for the presido election, Chichi Ojei of Allied People’s Movement (APM).

ADC's Dumebi Kachikwu, the Accord Party's Christoper Imumolen, the Action Democratic Party's Yabagi Sani, and the Zenith Labour Party's Dan Nwanyanwu also signed the agreement.

Remember say dem sign  the first peace accord for September 2022, wey dem start dia campaign.


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny

    High: 38°C | Low: 27°C