On Air Now

Una Wake Up Show

6:00am - 10:00am

Do Wetin You Say You Go Do or Dem Vote You Out, Buhari Dey Tell Governors- Elect

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Presido Buhari dey tell governors elect say make dem do wetin dem promise wen dem dey campaign.

Presido Buhari don call all di new governors elect to make sure say dem do all di tins wey dem tok say dem go do wen dem dey campaign. Na from di mouth of di Chief of Staff to di Presido, Prof. Ibrahim Gambari for Abuja on monday for di inductio wey dem do for governors by di Nigeria's Governors Forum(NGF).

"We don see say for di last election say di elctorate don dey wise up and pipo don dey put eye down for election mata. 

"Na wetin democrcy dey about be dis,Deliver or follow door comot.

Buhari still tok say by May 29, dem go call all di new governor elect make dem come start to handle all dii matas for dia state for di next 4 years. He tok say make dem make sure say dem do right by di people wey vote dem in as pipo eye don open now so no time to do anyhow and anybodi wey no do well, dem go vote am out for di next election.


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Thundery shower

    High: 36°C | Low: 26°C