On Air Now

Una Wake Up Show

6:00am - 10:00am

Di Remove of Illegal Buildings For Lagos

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Lagos Don Start To Remove Illegal Buildings For Banana Island

Officials of di Lagos State Building Control Agency(LASBCA) and di Lagos State Environmental and SPecial Offences Unit(Task Force) don start to dey scatter buildings for Banana Island wey no follow di Lagos State Urban and Regional Planning Development Law (2019).

Dis one dey follow wetin Governor Babajide Sanwo-Olu talk last weekend wen him visit di place wey dat seven-  storey building wey fall scatter for Banana Island. 

Governor Sanwo-Olu tok say di site of di building wey fall bin no dey di original plan for Banana Island.

 
Na General Manager of LASBCA, Arc. Gbolahan Oki and di Task Force Chairman, CSP Shola Jejeloye lead  di pipo wey dey scatter di building dem for Banana Island.


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Thunder storm

    High: 36°C | Low: 25°C