On Air Now

Non Stop Music

11:00pm - 6:00am

CBN Don Talk Say Na Lie, Say Di New Money Full Everi Where

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Central Bank of Nigeria (CBN) tok say na lie some Nigerians dey tok, say di new money no dey.

Musa Jimoh wey be di Director, Payment System Management Department of the bank come represent di CBN Governor, wey be, Godwin Emefiele, tok for one meeting wey dem do for Jos, say na lie, say di new money dey.

Him tok say, ''CBN don give other banks di new money wey dem do, say make dem put am for ATM and make dem dey give pipo for bank. Him still tok say, dis one na so dat di money go fit go round and say make other banks stop to dey give pipo di old money, if not, dem go get wahala''.

Emefiele dey advise Nigeria pipo say, make dem go put dia old money for bank, collect new one, say na for 31st of January, we go stop to use di money patapata.

CBN Governor still tok say as dem change di money good, say e show say dem dey upgrade with di world, he stil tok say, normally, na every five years we suppose to dey do new money and say he no happy say Nigeria pipo wait for nine years before dem change di money.

When dem go tok to some pipo for Jos about di new money, CBN Governor tok say di reason why dem change di big big money na so dat all those pipo wey dey collect money from bank go keep for house, dem go stop and money go fit dey go round.

He still tok say, make everybody carry dia old money go put for bank, say all those pipo wey dey hope say, dem go shift di the day  wey dem give to stop to dey use di old money wey be 31st of January. The day no go change and those pipo wey no change dia money go lose am.

#chookmouth


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Medium-level cloud

    High: 36°C | Low: 25°C