On Air Now

Football Republik

2:00pm - 8:00pm

Building Wey Fall For Lagos Don Kill One Persin

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Dem don confirm say one man wey dey work for one-storey building wey dem dey repair for Ikeja don die after di building fall ontop am and some pipo for Lagos State.

Di building dey for No.12 Aromire Avenue for Ikeja Local Government Area wey one supermarket dey use before, di man bin dey work some repairs for inside di building before e fall, come kill am.

The Permanent Secretary of the Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA), Dr. Olufemi Oke - Osanyintolu, confirm dis information on Wednesday.

Oke - Osanyintolu tok say di agency answer di heartbreaking call wey di pipo make and as soon as dem reach di place, dem find out say na unprofessionals dey work for di site and na im cause make di building fall.

After di whole wahala, di information wey dem gather show say di remaining part of di building wey no fall dey safe and e no put other buildings wey near am for danger.

Dem don lock di building.

#chookmouth


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny intervals

    High: 38°C | Low: 26°C