On Air Now

Closing Joli Joli

6:00pm - 11:00pm

Buhari Don Cut Ribbon For Di Second Niger Bridge,Others

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Presido Muhammadu Buhari don commission di 2nd Niger Bridge and six other big projects wey di Federal Ministry of Works and Housing don complete for di country.

Presido Muhammadu Buhari don commission di Second Niger Brigde wey dey di South East part of Naija. Dis one dey happen wen e remain six days make eim administartion end. 

Presido still cut ribbon for seven oda projects wey Federal Ministry of Works and Housing don complete for diffrent parts of Naija.

Na ontop computer our Presido take cut ribbon for all these projects.

Di oda projects wey Presido cut ribbon ontop na Loko-Oweto Bridge wey dey connect Benue to Nasarawa, di Ikom Bridge wey dey Cross River state, dem still finish one section of di Kano-Kaduna Dual Carriage Expressway, and three new Federal Secretariats.

Di Secretariats wey follow for dis one na one for Awka,Anambra State, One for Gusau for Zamfara and Federal Secretariat for Yenagoa for Bayelsa.

Presido wen eim dey do all this one come tok say infrastructure development dey very important for eim administration.

How una see di mata?
#chookmouth  
 


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny

    High: 38°C | Low: 27°C