On Air Now

Kulele Zone

2:00pm - 6:00pm

Bandit Burst Enter Kwara Church, Carry People Wey Dey Worship Go.

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Armed bandit dem burst enter one ECWA Church for Omugo community, Kwara State, on Sunday, carry plenty people wey dey worship go.

Security people sha later rescue three of di victims after dem do joint operation with police, soldiers, forest guards and local vigilante.

Dem say di attack happen as dem dey do normal Sunday service, and e cause serious fear for both church members and people wey dey live for di area.

As she dey confirm wetin happen, Commissioner for Communications for Kwara State, Bolanle Olukoju, talk say security operatives don rescue three people, and dem still dey work to free di rest wey dem kidnap.

She condemn di attack for church, say na coward act and e no dey acceptable at all.

She still beg residents make dem shine their eye well-well and cooperate with security agencies. She follow add say di forest combing operations wey dey go on don already start to reduce criminal activities for di affected areas.

Dis attack come as security tension don high for Kwara South, after intelligence report warn say dem fit get coordinated attacks for Ifelodun, Irepodun, and Isin local government areas.


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 24°C