On Air Now

Non Stop Music

11:00pm - 6:00am

Allowance wey dem no gree pay: Military Veterans go Sleep Outside Defence HQ

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Former military men wey dey under the aegis of Retired Members of Nigerian Armed Forces (REMENAF) and Coalition of Concerned Veterans (CCV) don join bodi block the Ministry of Defence inside Abuja.

Di former pipu don start di third phase of dia protest as dem no gree pay dia Security Debarment Allowance on Monday and dem spend di night for di gate of the ministry.

Ontop different pictures wey di spokesman of di CVV, Abiodun Durowaiye-Herberts send, you go see di ex-servicemen dey lie down ontop straw mats or stay ontop plastic chairs, even di wives of soldiers wey don die dey there

 

pension3pension2

 

 

Di military pipu wey don retire block road to di Ship House and dem don swear say dem no go comot there until dey answer dem.


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny

    High: 38°C | Low: 27°C