On Air Now

Closing Joli Joli

6:00pm - 11:00pm

Alaafin of Oyo, Lamidi Adeyemi Don join Eim Ancestors

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

The Alaafin of Oyo Oba Lamidi Adeyemi, don waka go meet eim ancestors on Friday night for inside the Afe Babalola University Teaching Hospital, wey dey for Ado Ekiti.

Dem don carry the body enta oyo state earli momo of Saturday to start the traditional rite wey dem go for if Alaafin die.

Governor of Oyo State, Seyi Makinde, go make official announcement wen Bashorun of Oyo, Yusuf Akinade, wey be the head of the ‘Oyo Mesi’, com tell am say Alaafin don die. Bashorun Akinade, na eim go lead Oyo until dem choose anoda Alaafin.

Oba Lamidi Adeyemi, dey 83 years old and eim be the  Alaafin wey don tey pass for the position of Alaafinof oyo, as eim dey there for 52 years.

Eim don dey sick tey tey, as eim be don even go abroad to collect treatment before eim die on friday.

Oba Adeyemi death go make am the 3rd senior Oyo State king wey don kaput year. Others na the Olubadan of Ibadan, Saliu Adetunji, and the Soun of Ogbomoso, Jimoh Oyewumi died. And e neva reach 5months wey e happen.

 

 


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 25°C