On Air Now

Una Wake Up Show

6:00am - 10:00am

2023: Police Dey Train Pipo Wey Go Fight Bomb

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Nigerian Police Force don arrange pipo wey know bomb wella keep for where dem go take enter and commot for we country, so dat nobody go fit bring bomb or bomb materials enter our country.

Inspector General of Police, Usman Alkali Baba, na him promise Nigerians say dis new force pipo wey dem arrange go comb through all di places wey e be like say all dis bombers go hide put , so dat dem go fit stop dem from transporting bomb materials or bombs come public places for dis 2023 General Election wey dey come.

He promise Nigerians dis one for Lagos, for di quarterly conference of commanders and heads of Explosives Ordnance Disposal (EOD) formation wey dey inside di country.

Di Commissioner of Police wey dey incharge for dat Unit wey come represent di IGP, Zannah Shettima tok say dem don train di officers wey dey work with Explosive Ordnance Disposal - Chemical, Biological, Radiological and Nuclear (EOD-CBRN) Unit finish.

For di training dem tok about how dem go fit discharge and off bomb safely and how dem go fit prevent bomb from public area for di General Election wey dey come, na Police Public Relation Officers, Olumuyiwa Adejobi, na im tok dis one.

#chookmouth


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Thundery shower

    High: 36°C | Low: 26°C