On Air Now

Non Stop Music

11:00pm - 6:00am

2023 Election: Ogun don declare holiday for PVC collection.

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Ogun state Government don declare tuesday and wednesday for no work-day for workers wey dey for public service. Dis na to make them go office of the independence national electorial Commission(INEC) or other places wey them fit collect dis permanent voter's cards.

According to the talk wey them drop on sunday by di oga for press to di governor, Kunle Somorin, di yarn follow after dem make di collection of new naira note to last till sunday, january 23, 2023 by INEC.


"Governor Dapo Abiodun don pity say make two days- tuesday 24th january and 25th january be no-work days to make public servants collect dia PVCs from local government wey dey closs to dem," Somorin talk am.

Eim said dat Gov Abiodun beg all the oga for public markets and private establishments wey dey for Ogun to make am easy for residents to go and get their PVCs 

As eim dey talk voting na waiting dey right wey people do, Somorin talk wetin Abiodun talk, say eim good make dem allow citizens wey get right to vote, to choose dia political leaders.

#chookmouth#


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Thundery shower

    High: 35°C | Low: 25°C