On Air Now

Oga Madam Office

10:00am - 2:00pm

2023 : Edwin Clark Don Choose Peter Obi for President.

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Edwin Clark wey be Ijaw national leader and also di chairman of PANDEF don show him support for Peter Obi to become president.

Di elder statesman choose Obi on Tuesday for one interview wey him get with media people for him house wey dey Abuja.

Clark dey ginger Nigerians say make dem no look person wey come from deir state, person wey dey practice di same religion with dem or wey dey di same political party with dem, make dem support Peter Obi because na him be ''the best hope for new Nigeria''.

''Him compare his Excellency Peter Obi with other pipo wey dey run for di Presidential election wey other parties bring as who go represent dem and him say him no get double mind, say our country Nigeria get opportunity to pick a wonderful team wey be di candidate of Labor Party, and him deputy, senator Datti Baba-Ahmed, as president and vice-president,'' him tok.

''I officially, hereby, announce say, I go personally vote for Peter Obi and him vice president for election day, wey be 25th of February, 2023, as president and vice-president of the federal republic of Nigeria.

''I dey also call on all well Nigerians no matter deir ethnic, religion or even political backgrounds to vote for Peter Obi without doubt as na him be our best hope for a new Nigeria of peace, stability, and progress.

''I don also ask di leadership of PANDEF, wey be democratic institution and all other socio-cultural and socio-political bodies wey I dey lead to tell deir members for states levels, local governments, and diaspora to join me support my choice Peter Obi''.

Clark also tok say Peter Obi plan to clean di dirty and yamayama places for south-south region of Nigeria dey strong.

Him show him support 48 hours after former President wey be Olusegun Obasanjo show him own support for Peter Obi as President.


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny

    High: 38°C | Low: 27°C