On Air Now

Non Stop Music

11:00pm - 5:00am

Wazobia FM, Nigeria Info FM Don Collect Right To Broadcast Di 2022 FIFA WORLD CUP.

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?
FIFA WORLD CUP FOR QATAR

Di Ogbonge Private Radio Group for inside Naija don get di right to broadcast Live football match dem for di 2022 FIFA WORLD CUP.

Dis special broadcast right go make di radio group to fit do live commentary for English, Pidgin and Hausa and dem go broadcast all di 64 match dem for ontop Nigeria Info FM and Wazobia FM wey dey inside di country.Di live match go follow dey for Cool FM and Arewa Radio wey be our Hausa-Speaking sister radio.

Di Chief Executive Officer for Cool FM, Wazobia FM, Nigeria FM, and Arewa Radio, Oga Serge Noujaim tok say dis partnership na to keep di promise to be di house for ogbonge  toktok, entertainment, and to carry increase di love wey Naija pipo get for football.

Femi Obong-Daniel wey be di General Manager For Corporate Communication inside di radio group follow put mouth for dis partnership mata.

Di World Cup go trek from November 20 to December 18 for inside Qatar.

 

How U See Di Mata ? #chookmouth


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 24°C