On Air Now

Koolele Zone

2:00pm - 6:00pm

Naija population, Dey Make life Hard-Ehanire

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Federal Ministry of Health don dey draw hand for ear as dem talk say you see the way our population dey grow eh, e go disturb our plan for economic growth.

Minister of Health, Dr. Osagie Ehanire, tok this one for inside  the launching of 2022 State of the World Population (SWOP) report Tuesday at the Press Centre of Radio House, Abuja.

Oga Ehanire, tok say "Nigeria population go soon reach is 214 million because of the high population growth rate wey dey 3.2% and our high total fertility rate of 5.3 children per woman.  

Eim come still tok say wetin follow dey cause this population growth, na because plenti married women no dey use drugs wey go help dem prevent pregnancy and dem no dey do family planning, wey come dey cause unwanted pregnancies.

 

 

 

 

 

 

 

According to am about 19% of  married women no dey use contraceptive and about 48% unmarried sexually active women self no dey use contraceptive.

"The amount of married women wey dey use contraceptive dey about 12% and that numba dey too low.

Dr. Ehanire tok say  Federal Government of Nigeria know say is one fit cause wahala for country's and dem don dey try to find solutions to the problem so that life to dey beta for pipu. 
 


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Light rain

    High: 33°C | Low: 21°C