On Air Now

Una Wake Up Show

5:00am - 10:00am

INEC Don Invite International Organization To Come Monitor 2023 Election.

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

The Independent National Electoral Commission aka INEC don invite international organization dem from obodo oyinbo to come follow put eye inside di 2023 General Election wey dey trek come.

Di Chiarman for INEC wey be Prof. Mahmood Yakubu na eim tok dis one on Monday 
when him welcome pipo from di Economic Community inside West Africa aka ECOWAS
wey happen for Abuja. 
Na di before Chairman for di Electoral Commission for Ghana,Dr. Kwadwo Afari-Gyan
na eim lead di ECOWAS pipo enter Abuja.

Oga Chairman for INEC tok say di reason why dem call di ECOWAS pipo to come chook 
eye for di election mata na to show say mago mago no go dey for di Election.

Di ECOWAS pipo follow meet Ministry Of Affairs pipo dem,di Inspector-General Of Police 
and di Civil society pipo dem.

 

How U See Di Mata ? #chookmouth 


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thunder storm

    High: 30°C | Low: 24°C