On Air Now

Oga Madam Office

10:00am - 2:00pm

COOLWAZOBIAINFOKIDS Celebrate Customer Service Week With Call for Teamwork and Better Work Spirit

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

As companies for all over the world dey celebrate Customer Service Week, CoolWazobiaInfoArewaKids don bring out plenty better activities to hail the people wey dey make the work sweet, their staff and clients.

With the theme “Teamwork/Collaboration: Exceptional Service Powered by People,” the station dey use this week take show say better customer service no be one department work, but na team effort wey dey powered by unity, creativity, and commitment.

The one-week celebration go start with Staff Day on Monday, wey dem dedicate to celebrate staff and remind dem about why e important to follow rules, work together, and always deliver better work.

For the day, dem go get appreciation time, where CEO Serge Noujaim go give award to staff wey don show correct service and commitment for the company.

The ginger no go stop there — from Tuesday reach Friday, the station go open door give clients make dem come do tour, presentation, and live studio experience for all the brands - Kids FM, Cool FM, Wazobia FM, and Nigeria Info FM for Lagos.

Clients go see as dem dey create their favourite shows from backstage, and also get chance to discuss new partnership and sponsorship opportunities.

The week no go dull, as entertainment and engagement go full ground — with games, live artiste performances, and plenty fun contests wey go make everybody enjoy.


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Heavy Rain

    High: 27°C | Low: 21°C