On Air Now

Oga Madam Office

10:00am - 2:00pm

Casualty for Calabar Gas Explosion Don Reach 60

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Health people don confirm say di number of victims wey di explosion affect for Calabar, Cross River State don rise go 60.

State Commissioner for Health, Henry Ayuk, talk this one when e visit University of Calabar Teaching Hospital on Sunday, where dem dey treat victims of the explosion.

Commissioner say di visit na to check how those wey injure dey do and to see how di medical team take respond to di situation.

According to am, about 60 victims wey get different level of burn injury dey receive treatment for di hospital Accident and Emergency unit after di explosion wey happen for Edibe Edibe area for Calabar South.

Eim still add say dem go transfer those wey get small burn go General Hospital Calabar, so that pressure go reduce for di teaching hospital and make treatment better for everybody.

Di commissioner no go alone, e waka with Special Adviser to di Governor on General Duties, Ekpeyong Akiba. Dem meet di Chief Medical Director of di hospital, Ikpeme Ikpeme, wey brief dem on how di victims dey and how dem dey manage their treatment.

Earlier, state government bin confirm 30 victims on Saturday when Governor Bassey Otu visit di explosion scene and promise say government go pay all di medical bills of di victims.

Report say na gas leak for one gas plant cause di explosion, wey later trigger big blast wey damage buildings around and injure people wey dey stay that area.

Di visit by health officials na part of emergency response by di state government, as dem still dey monitor victims and make sure say dem get all di medical care wey dem need.


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thunder storm

    High: 29°C | Low: 22°C