On Air Now

Oga Madam Office

10:00am - 2:00pm

Wilfred Ndidi don wonjure

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Di Nigerian player no go feature against Algeria dis Tuesday.

Wilfred Ndidi no go join Super Eagles to play against Algeria as eim don get hamstring wonjure.

Jose Peseiro, di Nigerian Coach don make dis one clear in interview with NFF TV say na wonjure do make Ndidi commot camp, go back England.

Di Portuguese born coach don tok say di injury no dey too serious but eim no go like take risk with Ndidi.

Nigeria wey never win Algeria for di last 3 matches go play without Ndidi and other players like Leon Balogun and Victor Osimhen.

 


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 24°C