On Air Now

Closing Joli Joli

6:00pm - 11:00pm

Why Victims Dey Stay Inside Abusive Relationships?

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Plenty pipu wey dey inside relationship for inside we obodo naija, don experience on form of abuse inside their relatioship. And this abuse don effect many of dem emotionally, even some of them don die because of this matter.

According to touchlighting wey BMCwomenshealth do. E show say Almost one inside four women for we obodo Nigeria don get abusive relationship. this one show say dis matter don tie beta wrapper siddon put inside wey obodo naija. 

This na why ontop #OgaMadamOffice show #Cheche siddon with sabi pesin ontop law mata, Kene Akaha. So that dem go fit chook mouth for this mata of relationship about inside women's corner.

Akaha, tok say plenti women wey dey inside dis type of relationship dey find am hard to waka commot, even when you dey try help, dem go start today fight you. and the reason na because some of them don dey use to the abuse and dem com dey see am say na so man suppose behave to dem.  

Kene Akaha, com even tok say some other women, the reason why dem no fit waka na say, dem no get money. And na the man dey give dem everi thing wey dem need. And some na because wetin pipu go tok. But all dis reason make Cheche come dey ask shey any reason dey good enough for pesin to siddon inside relationship wey dey abusive?

Oya chook mouth inside this matter tell us if you think say any reason dey enough for pesin to siddon put for abusive relationship.


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Thundery shower

    High: 36°C | Low: 25°C