On Air Now

Closing Joli Joli

6:00pm - 11:00pm

Why African Society Get Problem With Caesarean section?

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

According to the Agence Française de Développement (AFD) funds, Africa get fertility rates of 4.5 children per woman. An this one na the highest for inside the world. But just as the fertilty rate high, na so the rate of children wey dey die during child birth take high.

Caesarean section wey some pipu stil dey call C-Section or caesarean delivery, na process wey dem dey use surgery take help mama wey e dey hard for to born pikin the normal way.

For inside plenti african communities, no dey like to use this way take born dia pikin. Even after dia dokita go don advise dem say the natural style to take born pikin fit cause wahala for dem.

Ontop #WomensCorner for inside #OgaMadamOfficeShow, Chechesmithnation tok about why dis mata be like this inside we obodo africa, wetin make society dey look women wey born with C-section less. She also tok say the one wey dey pain her pass na the pipu wey dey use religion as excuse.

Many of dem dey use, the bible verse wey tok how hebrew women take dey give birth, as their excuse. but the question wey Cheche us answer dem na shey you be hebrew woman?

Many pipu calling in to share dia own experience ontop the mata, oya watch the full video to see wetin dem tok about the whole mata.


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny

    High: 38°C | Low: 27°C