On Air Now

Una Wake Up Show

6:00am - 10:00am

Show Promoters Dey Get Budget For Everything Except Hypeman - Toby Shang

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Fast rising hypeman, Toby Shang. tok about how show promoters dey get money to pay everybody except hypemen.

Toby Shang, wey be the official hypeman for afrobeats superstar Naira Marley, enta our studio to follow Cheche Smith talk about eim new single #Update, on top #Spotlight inside #OgaMadamOfficeShow.

CheChe ask am about the business side of hype, and whether hypemen dey see beta money. Toby Shang tok say show promoters no dey like pay hypemen. Because dem dey feel say na dem they give hypemen platform to take shine.

Toby Shang tok even himself when eim start dem be no dey pay am, until eim come dey work with Naira Marley na wen eim come dey get beta money wey eim fit take hold eim side.

Eim even tok say money artist dey get inspiration and lyrics for song from hypemen inside clubs, so eim dey advise all hypemen wey dem dey put eye down ontop how dem dey release they material, wey anoda person no go copy am.

Cheche still ask about eim plan for album, and if eim get best friend for inside the industry. So make you watch the video to get the full gist with Toby Shang.


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 25°C