On Air Now

Kulele Zone

2:00pm - 6:00pm

I Been No Like PDA But Chichi Make Me like Am - Deji

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Three housemates carry dia kaya commot for inside the Big Brother Naija season 7 on Sunday. For the eviction wey be the number 5 eviction show for the season, we see Deji, Diana, and Giddyfia become the 9th, 10th, and 11th housemates to carry waka commot for the show.

We get opportunate to follow dem talk about dia waka for the show as dem enta we #ChookMouthStudio to follow CheChe Smith tok.

Cheche ask Deji about wetin make am choose Chichi out of all the girls wey dey inside the house. 

Eim say when dem enta the house none of the babes for the house been dey enta eim eye, but as eim come dey get to know dem beta and eim come dey see say everibodi don dey gum bodi so eim just settle down with Chichi because eim get soft spot for her.

According to Deji eim yarn say before dem enta the house eim been no like to dey do Lovey lovey outside but Chichi make am like am.

Our watch the full video top catch the full siddon tok.


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Thundery shower

    High: 36°C | Low: 26°C