On Air Now

Oga Madam Office

10:00am - 2:00pm

E take Yemi Alade 5 Years To Reply My DM - GUCHI

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Ugochi Lydia Onuoha, wey many pipu know as Guchi na Nigerian Afropop/ Afrobeat singer. And she be one of the young female artiste wey dey show say dem no come play for the music industry.

She drop her latest single wey she call " I Swear" and inside she join body with powerful female Afrobeats superstar Yemi Alade.

When Guchi siddon with our Cheche Smith she tok about her new single and how long wey she don wan work with Yemi Alade.

According to Guchi she say she send Yemi messages for DM since 2016, and na 2021 Yemi finally see her DM, come invite her to come meet her for house.

She also tok about the how Yemi take do her well and come jump ontop her latest song. 

Oya watch to see everi everi wey she tok for the siddon tok with Cheche Smith for ontop #Spotlight inside Oga Madam Office show.

 


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Thundery shower

    High: 36°C | Low: 26°C