On Air Now

Oga Madam Office

10:00am - 2:00pm

Dem Don Serve Me Breakfast- Ugoccie

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

One of the young sisi wey dey scatter social media with her singing and rapping skills, Ugoccie enta we studio to follow us tok about her new single wey she drop and she put Phyno inside.

Ugoccie wey burst out scatter very where for social media, during 2020 lockdown wey everybody siddon for house for lockdown. Don come with anoda banger for her fans.  She enta we studio to follow Cheche tok about  this her new banger, ontop #Spotlight for  #OgaMadamOfficeShow.

Cheche ask her how she take get phyno to jump ontop her jam. Ugoccie tok say she being dey dream to work with Phyno, but na one of her friend na eim connect her with Phyno. And  dem link up, she play plenty song for am, but Phyno just fall in love with Breakfast.

Cheche also ask her about where the inspiration for the song take come from, Ugoccie tok say she self don collect better breakfast and na eim make she come turn am to song, because she don experience am. 

To find out the person wey serve Ugoccie breakfast you go need to watch the video.


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 25°C