On Air Now

Oga Madam Office

10:00am - 2:00pm

Evangelism Wahala!!

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Wahala as Women wey come preach for Bar insist say the men wey dey drink for the Bar must stand up for prayers.

Two women enter inside bar wey men dey drink and watch Match begin share pamphlet, next thing dem ask the men to stand up for prayers and worship, the men confuse dey look dem.

The owner of the Bar vex tell the women say dem don overstep their boundaries and no fit come him shop dey harrass him customer but the Women no gree oh, dey kan dey para tok say dem dey stop dem from doing the work of God.

Who dey at fault for dis mata? The Owner of the Bar or the Women wey kan preach?

Na the mata wey Chiboi and Adadumdum siddon tok ontop #trutalk inside #kulelezone.


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny

    High: 38°C | Low: 27°C