On Air Now

Closing Joli Joli

6:00pm - 11:00pm

PUMA don cancel di 1 billion naira contract with The Athletics Federation of Nigeria (AFN)

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

PUMA, one of di leading Sports wear brand don terminate di 4-year contract wey dem bin get with AFN sake of say Nigeria no wear di kits for Tokyo Olympics 2020

Di major highlight of di contract be say PUMA suppose supply kits to all categories of Nigeria athletic team till 2022.

Dis agreement bin also include money for any athlete wey go wear di sportswear for medal presentation during di Tokyo 2020 Olympics. $15,000 for gold medalists, $5,000 for silver medalists and $3,000 for bronze medalists.

But di problem be say Sunday Dare di Minister of Sports and Ibrahim Gusau di President of AFN get serious quarrel. Na dis dis gbege do make Sunday Dare no gree make Nigerian Athletes wear di PUMA kits for Olympics.

At dis point, PUMA come change mind, tok say dem don terminate di contract because of breach in agreement. 


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Medium-level cloud

    High: 36°C | Low: 25°C