On Air Now

Closing Joli Joli

6:00pm - 11:00pm

Nigerian footballers in the EPL (2021/2022 season)

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Nigerian footballers in the English Premier League (2021/2022 season)

Di much awaited 2021/2022 EPL season been kick-off on di 13th of August as Arsenal bin travel go Brentford for di match wey dem bin lose 2-0 to the Bees. 

One of di players wey bin dey very outstanding for di opening game na di Brentofrd player FRANK ONYEKA. Him be Nigerian wey don get 3 call-ups and 1 appearance for di Super Eagles. 

Brentford no be di only EPL club wey get Nigerian players - that is players wey don make at least 1 appearance for di Super Eagles.

Watford follow dey dis list with 3 players - PETER ETEBO, EMMANUEL DENNIS and WILLIAM TROOST-EKONG. Isaac Success wey bin get 5 year contract with Watford dey likely to go Udinese for Italy as transfer talks don already open between the two clubs.

ALEX IWOBI dey play for Everton and Leicester City wey bin win FA Cup last season (2020/21) get WILFRED NDIDI and KELECHI IHEANACHO. 

Nigeria’s Super Eagles be one of di favourites to kolobi di 2021 CAF African Cup of Nations wey go happen for Cameroon.


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Medium-level cloud

    High: 36°C | Low: 25°C