On Air Now

Closing Joli Joli

6:00pm - 11:00pm

Brighton Star Enoch Mwepu Don Retire By Force Because Of Him Heart Condition

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

The Brighton midfielder Enoch Mwepu don retire for the of age 24 beacuse of him serious heart palava wey him get.

According to the result after test,the club tok say the sickness na hereditary cardiac condition and e fit worse if him continue to dey play but say the only option na for him to retire from football .
Mwepu tok say him no happy as him dey retire like this but him manage to reach him dream wey be to play for premier leaugue.
Meanwhile,Mwepu bin fall sick for inside plane as him dey go join him fellow Zambia teammates for the international break wey happen last month but Mwepu end up inside hospital for four days as him reach Africa.  

Enoch bin join the team from Red Bull Salsburg for July 2021 ontop four year deal and him don play twenty seven match with three goal for Brighton.Him last match na against Leicester wey dem win 5-2 for september.
The former midfielder don tok say even if him stop to play him no go comot hand for football matter.


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny

    High: 38°C | Low: 27°C