On Air Now

Closing Joli Joli

6:00pm - 11:00pm

Barcelona don drop to UEFA Europa League

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Robert Lewandowski former team bin kpakuka Barça 3-0 for Nou Camp putting an end to 2022/23 Champions League dreams

Barcelona for di second season in a row go play thursday night football as dem no bin gather enough points to take commot from di Champions league group wey get Bayern Munich and Inter Milan. 

Dis setback fit even draw di club backwards financially if dem bin dey expect monetary returns from Champions league dis season.

Real Madrid be di only La Liga team wey go remain for Champions league as Atlético Madrid and Sevilla don follow jabo.


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Thundery shower

    High: 35°C | Low: 25°C