On Air Now

Satide Waka

10:00am - 2:00pm

Tinubu No Show As Atiku, Obi, and Others Sign Peace Agreement.

The pipu wey dey represent the different political parties for inside the presido election and dia party chairmo don come sign agreement say dem no go do anytin wey go make gbege before go reach afta the election for 2023.

Dem sign the agreement wey the National Peace Committee arrange inside Abuja on Thursday.

Some of the candidates wey sign am na Peter Obi of the Labour Party, Atiku Abubakar of the Peoples Democratic Party (PDP),  and Rabiu Kwankwaso of the New Nigeria Peoples Party (NNPP).

But the candidate of All Progressives Congress (APC), Bola Tinubu, no come the place but eim send eim running mate Kashim Shettima to help am sign the agreement.

Video even come out wey show one of the candidate Omoyele Sowore of African Action Congress dey vex say Oga Tinubu send eim running mate Kashim Shettima to come siddon for eim chair as eim no dey around.

 

Other candidates wey sign the agreement na Hamzat Al-Mustapha of Action Alliance, Omoyele Sowore of African Action Congress,  Sunday Adenuga of Boot Party, Chichi Ojei of Allied People’s Movement (APM) and she be the only woman wey dey follow join bodi drag for the presido chair.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 28°C