On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

Tinubu go Head Di Second FEC Meeting Today

Presido Bola Tinubu go siddon as oga for di Federal Executive Council (FEC) meeting on Monday morning.

On Sunday, di minister of finance, Wale Edun, announce say di 2024 budget and di $1.5 billion loan wey dem dey find from World Bank go be di koko for di meeting.Nigeria dey find loan to support di kontri budget.

Di Monday FEC meeting go be di second one since Tinubu inauguration as Naija presido for 29 May. Di  first one happen for 28 August.

FEC meetings dey normally happen every week.Di presido normally dey head and di vice presido and all do oda cabinet members go dey there.
Na di cabinet dey make d important decisions like to approve contract for di meeting.

How una see di mata?
#chookmouth


 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C