On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

Tinubu Don Appoint Ola Olukoyede as Di New EFCC Chairmo

Presido Bola Tinubu don appoint Ola Olukoyede as Chairmo of di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC).

Presidential tok tok pesin,Ajuri Ngelale, announce dis one for one statement on Thursday.

Ngelale explain say "Ola Olukoyede go serve as di oga of di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) for four years tenure wey e fit come back for anoda tenure depending on Senate confirmation."

Before him appointment, Olukoyede bin serve as Chief of Staff to di Executive Chairman (2016-2018) and Secretary to di Commission (2018-2023).

Di appointment happen afta di former chairman of EFCC, Mr. Abdulrasheed Bawa bin resign afta dem suspend am. 

Di President also approve di appointment of Mr. Muhammad Hassan Hammajoda to serve as di Secretary of di EFCC for term of five years wey e fit come back depending on  Senate confirmation.

"Tinubu don give di new oga of EFCC work of to make sure say di anti -corruption pillar of di Presido Renewed Hope agenda go wok well well", as di statement take read be that. 

How una see di mata?
#chookmouth


 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C