On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - Midnight

School Girl Death: Lagos State Don Close Chrisland School

Lagos State government don tok say make dem close Chrisland School wey dey Opebi Road for now, because of one 12-years-old pikin wey be student for di school wey die.

Di State Commissioner of Education, Folasade Adefisayo, tok on Sunday say dem no go open di school until dem chook eyes well for di matter, come know wetin kill di pikin. 

Whitney Adeniran die on Thursday wey be 9th of February 2023, when di school dey do deir inter-house sports competition for Agege Stadium.

Nobody really know, wetin kill am.

Di school and di doctor wey check di girl, tok say, she faint, come die of heart attack, but her papa believe say na electric shock na im kill di 12-year-old.

Di Commissioner of Education don tok with her papa and she don beg am say make him stay calm, as dem dey chook eyes for di matter.

#chookmouth

 


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C