On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

Lagos rail: Blue line go start work by 1st quarter 2023

The Lagos State governor, Babajide Sanwo-Olu, don nack hand for chest tok say blue and red line rail projects go soon start work.

The governor tok am wen eim go check the work for National Theatre in Iganmu, Orile. 

Oga Sanwo-olu tok say as eim dey see the work the work don dey reach 9o% percent, and with the way the work dey go kpata kpata by the first quarter for inside 2023 the work suppose don ready.

dem dey wait for two sets of four-train coaches wey dey come from China inside September and October, and dem don arrange beta security for inside everi station and platform with  CCTV.

The blue line rail go run ontop electric tracks, and governor dey draw ear dey warn pipu  make dem no waka ontop am.


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 34°C | Low: 28°C