On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

IPMAN Don Draw Dia Ear Dey Shout Say Petrol Fit Scarce oooo

The Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria (IPMAN) don dey knack agogo dey shout say with the way mata dey go like this e be like say petrol fit scarce. Because dem neva give dem dia N500 billion.

This money na for wetin dem dey call bridging claims. Bridging na the amount wey e dey cost dem to transport petrol from refinery and depot  go reach filling stations wey pipu go come buy am.

The IPMAN chairman for Kano, Alhaji Bashir Danmalam, tell tori say pipu wey government no siddon look ooo. Make dem come chook mouth for wetin dey happen for inside the Nigerian Midstream and Downstream Petroleum Regulatory Authority (NMDPRA), So that dem go fit pay dia member ooo, make petrol no come scarce for obodo naija.

Eim also hala say since dem join  the Department of Petroleum Resources, the Petroleum Equalisation Fund, and the Petroleum Products Pricing Regulatory Agency into the NMDPRA. Na only two times dem don pay the markets. 


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C