On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

Ifeanyi Ubah Don Comot For YPP, Don Join APC

Di Senator wey dey represent Anambra South, Ifeanyi Ubah, don comot for di Young Progressives Party (YPP) to go join di All Progressives Congress (APC).

Di President of di Senate, Godswil Akpabio, announce say Ubah don change party go di ruling party for floor wen di Thursday plenary dey happen.


Senator Ubah, according to di Senate President,  tok say na differences wey dem no fit settle na eim make am comot for YPP. 

Wen Senator Ubah dey tok to tori pipo, he explain say dis him decision na for di good of him constituents.

Na under di Young Progressive Party he win election (YPP) for 2019 and dem re-elect am for 2023.


How una see di mata?
#chookmouth


 


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 32°C | Low: 26°C