On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

Federal Government Don Award 450 Nigerians And Foreigners With National Honour.

The Minister For Special Duties And Intergovernmental Affairs wey be Sen.George Akume don tok say na 450 out of the 5,000 nominees collect the 2022 National Honours Awards for their contribution for the country.

The Minister For Special Duties And Intergovernmental Affairs wey be Sen.George Akume don tok say na 450 out of the 5,000 nominees collect the 2022 National Honours Awards for their contribution for the country.

The Minister talk this one for him welcome speech for the National Honours Awards wey happen inside Abuja on Tuesday. Him talk say the Award na according to National Honours Act of No 6 for 1964 wey begin for Oct 1,1963 to dey honour citizens wey don contribute for the developement and progress of the country for any kind work wey dem dey do. This year,the award follow reach foreigners hand as them call am Nigerians and
 friends of Nigerians Awards. For inside the award,people wey contribute for the developement but don die follow collect the posthumous award. This people wey include,former Chief of Staff to president,late Abba Kyari(CFR),former Chief of Staff,Lt.-Gen.Ibrahim Attahiru and Aircraft Man Matthew Oyedepo,wey die inside plane crash for May 2021.
 
 Vice President Yemi Osinbajo,Senate President Ahmed Laman,Oga Speaker for the house of Rep.Femi Gbajabiamila,CJN Olukayode Ariwoola,Chief of Staff,Prof.Ibrahim Gambari and other important people bin present for the Award.


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 35°C | Low: 27°C