On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - Midnight

FCTA Don Warn Pipo Wey Get Illegal Hotel Make Dem Close Am Down.

Di FCT Administration on Thurdsay don warn landlord dem inside Abuja wey dey turn dia house to hotel,motel and brothel say make dem shut down sharpaly or dem go lose ownership of dia house.

Di Coordinator for Abuja Metropolitan Management Council,Umar Shuaibu don tok say na dis plenty illegal motel and hotel dem dey cause insecurity for inside Abuja.
According to am, eim dey worry about how most of di hotel inside Abuja no dey get di profile of dia customer dem,say dis kind thing fit create comfort for criminal dem inside di federal territory.

Him come tell hotel owner dem say make dem rergister dia hotel and make dem follow gum body wit security pipo dem to help cacth criminal pipo.
According to di coordinator eim say dis warning no be play mata and say eim give landlord wey wan do di hotel business one week make dem go register dia hotel.

 

How U See Di Mata? #chookmouth 


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C