On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

Davido Don Delete Music Video Wey Vex Eim Fans

Na so pesin go just dey chillax, oo wahala go find you reach chilling spot. David Adedeji Adeleke wey many pipu know as Davido, been post one video for on top social media last week, to take promote the music of Logos Olori wey be one of the new artist wey eim sign.

E come be like say video no siddon well for the belle of some of eim fans, as dem start to tell am make eim delete the video becos e no respect dia religion.

The video show some muslim men dey dance for front of mosque, then Logos Olori come siddon on top the roof of the mosque, na so plenti muslim pipu for social media dey vex dey drag Davido say the thing no make sense as he post the video.

Forma media aide to former Presido Muhammadu Buhari, Bashir Ahmad tok say make the singer tell pipu wey the video no sweet for belle no vex, and come commot all the part wey make dem dey vex for inside the video before dem go release the music.

 

Even Senator Shenu Sani follow chook mouth for the mata, eim tell Davido make in hear wey him fans dey tok and delete the video.

Afta all the plenti tok the singer commot the video on top eim social media page, but eim no tok anytin about the video or tell eim fans wey the video vex sorry. 

Oya see how pipu take para about the mata.

 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C