On Air Now

You & Yaw

9:00am - 11:00am

Chicago State University Don Release Presido Bola Tinubu Academic Records

Chicago State University (CSU) for United States on Monday release di academic records of President Bola Tinubu to former Vice Presido Atiku Abubakar.

Chicago State University ,release di documents to Atiku on Monday based on order wey one United States District Court wey dey for di Northern District of Illinois give.

Di US district judge wey dey handle di case, cancel President Tinubu objections and rule in favor of Atiku Abubakar.

Di court yarn CSU make dem run go produce di documents wey dey relevant and arrange for di deposition of dia corporate person wey go fit meet di deadline wey di Supreme Court of Nigeria give wey dem set for 5 October.

Atiku bin ask for copy of President Tinubu diploma wey CSU give am for 1979.

But, CSU talk say dem no dey usually keep copy of student diploma and afta dem waka up and down to search, dem no fit locate copy of di original diploma wey dem give Tinubu for 1979.

Atiku wan use di academic record as part of im appeal wey e wan carry go Supreme Court of Nigeria, wey e go challenge Tinubu victory for di 25 February presidential election.

Atiku bin run for president as di candidate for People's Democratic Party.

 

How u see di mata? #chookmouth

 

Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C