On Air Now

Go Slow Yarn

6:00pm - 11:00pm

Mike Abdul Tok About Praise Jam And Eim New Song With Ada Ehi

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Gospel artist, producer, and songwriter. Mike Abdul  enta we studio for #OgaMadamOffice to follow #Chechesmith tok about wetin pipu go dey expect from one of the biggest gospel concert of the year Praise Jam.

Mike wey be one of the artist wey go headline Praise Jam, #Theresurrection!! 2022. Also tok say make eim fans expect eim latest jam wey go soon drop. Eim say the name of the song na, '' Hallelujah Always'' and no be only am dey ontop the song.

Mike say eim collabo with one of the biggest female gospel artist for we obodo Naija right now wey be  Ada Ehi . For fans wey still neva get dia Praise Jam ticket, dem fit go for ariiyatickets.com, all Tastee Fried Chicken and Chocolat Royal outlets,

Praise Jam #TheRessurection go happen on 18th of April 2022, for inside Eko Hotel Convention Center. By 12pm for inside Lagos state.


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 23°C