On Air Now

Koolele Zone

2:00pm - 6:00pm

How woman fit take prevent cancer

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Every minute inside obodo the world, one woman dey die of breast cancer. that na why as woman you suppose put eye dey check your body.

Che Che siddon talk with Chioma Okonkwo wey be nurse and oga for @fruitnurse_ng.  Chioma talk say as woman once your breast dey produce milk wen you no dey pregnant and you no dey breastfeed try see doctor, make dem know if na breast cancer.

When be last time wey you check your breast to know whether you get any of the symptoms of breast cancer. incase you no know the symptom of breast cancer. If you dey get any pain of your nipple dey enter inside, if you see any koko (lumps), and your nipple dey commot water or something wey be like milk. 

If you see any of this kind symptoms e beta make you go meet your doctor for check up, to avoid any story that touch


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 24°C