On Air Now

Koolele Zone

2:00pm - 6:00pm

Breastfeeding week: Things wey dey fear women about breastfeeding

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

World Breastfeeding Week 2022 start from Monday, 1 August go reach Sunday, 7 August. And this year own the theme na #StepUpForBreastfeeding.

Them dey ginger more mama dem, make them no carry breastfeeding mata play at all. because of the beta beta things wey breastfeeding dey do for pikin dem.

Ontop Health Corner for inside Oga Madam Office Show, Cheche Smith no take this mata play at all as she carry beta sabi pipu ontop breastfeeding mata enta studio for two days, so that dem go fit chookmouth ontop the mata.

The sabi pipu wey be Dr. Chinny Obinwanne, wey be Medical Doctor and founder and The Milk Booster. Anoda sabi pesin na Dr. Kelechi Okoro, wey be Medical Doctor, Health Influencer and Founder: Heal for Africa, Health Hub for Africa.

Dia two naim join chook mouth ontop this mata. Oya watch the video to see as dem piece all the things wey make women dey fear breastfeeding


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thunder storm

    High: 30°C | Low: 24°C