On Air Now

Non Stop Music

11:00pm - 5:00am

​​​​​​​2023 Elections: LP’s Adegeye Don Win HOR Vote For Amuwo-Odofin, Lagos

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Di Independent National Electoral Commission (INEC) don tok say na Labour Party House of Representatives (HOR) persin for Amuwo-Odofin, wey be George Adegeye, na him win di Saturday election.

Adegeye use 46,702 correct votes take win Prince Lanre Sanusi wey be All Progressives Congress (APC) persin, wey only get 12,946 votes.

Di People’s Democratic Party’s (PDP) Oghene Ego wey na him bin dey di House of Representatives, na him carry third for di waka with 5,752 votes.

Di persin wey dey work for INEC for Amuwo-Odofin Federal Constituency, Professor Abayomi Okanlawon na him call Adegeye as di winner of di  election for where dem dey count di votes for dat area.

Adegeye dedicate him win to him late mama wey him tok say go dey very happy about dis win.

He tok say, ''di whole waka worth am and di end dey very satisfying''.

He still tok say, “I don tok am before and I dey tok am again say, I dey on a mission to finish my late mama wish wey be to free di good people of Amuwo Odofin Federal Constituency and as all of una don give me dis opportunity, I promise una say I go use am well,”.

#chookmouth


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thunder storm

    High: 35°C | Low: 24°C