On Air Now

Oga Madam Office

10:00am - 2:00pm

Why We Sack 1,000 Teachers-Anambra State Govt

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Some teachers inside Anambra State go do protested for Anambra State House of Assembly, as dem say make Members of the house chook mouth ontop the sack letter wey goverment give dem.

The goverment of Anambra state don come out now dey tok about why dem tell 1000 teachers for inside the state say dem no get teacher work again for inside the state schools.

Dem say dis teachers dem, the way dem take get the work no make sense at all, and some of dem no even get the kpali wey dem need to take get the work.

The Press Secretary of Governor Chukwuma Soludo, Chris Aburime naim come out come tok this one. Eim even tok say dem no sack any teacher wey sabi the work and come get the kpali wey dem suppose get.

Oga Aburime, tok say the former administration under Governor Willie Obiano, employ some people wey dem call PTA teacher. The goverment tell dem say to make sure say the employment process no get any K-leg make dem  do the online teacher recruitment test.

Because dem wan make sure say all teachers wey dey the state sabi the work wella. 


Who Be PTA Teachers?

Because of say students for schools inside Anambra states during oga Obiano administration, no get enough teachers for the schools. 

The Parents/Teachers Association (PTA) inside different school for the state, come find people wey go fit come dey teach for the schools wey no get enough teachers.

But as Oga Obiano dey commot for inside office eim com  converted dem to permanent staff in Anambra State schools before eim commot office.


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 24°C